Seems that Mugabe's decision to make his wife the heir apparent rather than his Vice President (who apparently wanted to bring back white farmers and make amends with the IMF etc..) may have backfired as troops have been deployed on the streets and a possible coup may well be underway.
https://www.bbc.com/pidgin/tori-41987363
https://www.bbc.com/pidgin/tori-41987363
Di mood for Zimbabwe dey mixed after army draw ear give President Robert Mugabe make im stop di sack sack of people wey fight for independence for inside di ruling ZANU-PF party.
On Monday, Army chief general Constantino Chiwenga draw ear give Mugabe to stop after im sack Vice President Emmerson Mnangagwa.
Dis na di latest sack wey according to tori na to pave way for Grace Mugabe to succeed.
Chiwenga talk say if things no change, army go fit step in. ''Di thing wey dey happen now for inside di ZANU-PF party by people wey no get di freedom history of di party no surprise us…''
''We get to remind di people wey dey behind am say wen e reach to protect our revolution, di military no go hesitate to step in.''
Di army oga talk dis one for tori meeting for Harare. Chiwenga, Mnangagwa and Mugabe all gather for di fight for independence from Britain.